Dr Kabiru Gets wey be Kano state Commissioner for Health, talk say na Naija still dey carry first for Tuberculosis (TB) for Africa O. Na so he yarn on Friday when he dey talk to news pipu for Kano. He say estimate wey dem just do show say na like 600k pipu get am for 2014.
He still say over 500,000 pipu, na him get Tuberculosis for Naija wet dem no even Sabi, talk less of say dem go treat am and TB na wetin dem fit treat if dem quick see am. He say Kano dey among States wey get am pass cos e be like say na like 30k pipu dey get am for there. He say for 2015, the state fit catch and treat 6,023 pipu wey get am and 5,550 of dem na adult plus 428 children.
No comments:
Post a Comment