Thursday, June 2, 2016

AS E DEY HOT: GBENGA OGUNBOTE DON BECOME NEW COACH FOR 3SC

Na yesterday tori dey waka say the bros don resign from Giwa FC wey he bin dey before dem pursue dem commot from league sake of say dem do some mis-do. Tori dey confirm am give us say 3SC don confirm the ogbonge coach as person wey go take over afta Khadiri Ikhana commot last month. So we dey expect say na dis afternoon dem go show him face give 3SC fans but he don already dey ground for the club as he don meet players yesterday. Boss abeg come do magic O, make Shooting no go relegation ooo.

No comments: