Saturday, May 7, 2016

SUMBIE OF SPACE FM DON POLONGO MOVIE DAY OUT WITH SUMBIE FOR CHILDREN

ONE of we ogbonge OAPs for Ibadan city wey get special anointing for children, Olanrewaju Sumbo wey everybody sabi as Sumbie for Radio don polongo Movie Day out for her constituency, wey be children as children's day dey Waka near us. Sumbie wey be one of the pioneer staff for Space FM and a Mass Comm graduate from Leadcity University dey anchor one children show for Space FM, wey dem call Brain Teasers and children like the show so tey dem nominate am for last NBMA. As she come dey try now to make am bigger. She don ready to do essay competition for children,  and wetin dem go write on top na 'What I want for the Nigerian Child' wey no go pass 100 words and dem go send am to sumboOlanrewaju@gmail.com. The main thing go shele for children's day wey be May 27th but to submit go end for 21st May.  So she go pick pikin wey try and dem go follow her go watch film for children's day for one of the cinemas wey dey town. We say nice one from SUMBIE. Incase una no Sabi, Sumbie na kida-Kudz sister.

No comments: