Thursday, March 6, 2014

FEDERAL GOVERNMENT SAY MAKE FEDERAL GOVERNMENT SCHOOLS CLOSE DOWN FOR DEM BOKO HARAM STATES



Make e no be like say person dey take fire play na him make Federal Government talk am Yesterday say make all Federal Government Colleges wey dey the 3 Boko Haram States, Borno, Yobe and Adamawa 

 
say make dem close for now as e be like say na dem boko boys dey find o (If Federal Government fit close dem schools, I wonder wetin Private Schools go do)

We go remember say na last week the wicked boko boys go fall 40 pikins wey dey sleep jejely for their hostel for one Federal Government College wey dey Borno. Dem say those of the students wey wan write WAEC dey go write am for another Federal Government College wey dey Bauchi.

Na Oga Minister for Education, Mr. Nyesom Wike talk the matter through him megaphone, Simeon Nwakaudu for Abuja yesterday.

No comments: