Saturday, May 7, 2016

OYINBO...UNA NO GO KILL US WITH FASHION SHA.



Miss Simplicity - Kanye West and him wife Kim Kardashian naim fashion publication wey still be Met Gala annual organizer don pick as d best dressed couple for d Met Gala event wey shele on Monday for New York. Dem tok sey na only Kanye nd Kim naim follow d theme for dis yr Met wey be "Manus x Machina: Fashion in Age of Technology' hmm una go fear oyinbo theme naw. Kanye nd Kim come d event wit outfit wey Olivier Rousteing wey


 be creative director for Balmain design for dem... Kanye wear denim wey dem don tear for front, Silver studded jacket nd him com nack blue contact lenses for him eye to match him dressing, then Kim wear long-sleeve robotic gown wey fit her body wella come d party... Hmmmmm Oyinbo pipu nd their wahala, I sha knw sey fashion no go kill dem oooo....anyway we sey
 congratulobia to Kanye West nd Kim Kardashian....

No comments: