Senator Femi Lanlehin wey dey stand for Oyo South in the
senate talk many things for one interview wey he do with Vanguard Newspaper,
part of things wey he talk be say hin no dey beef bro Isiaka Abiola Ajimobi,
Oga Governor of Oyo State and he never start dey dream see himself for Agodi
Government House in Oyo State.
When Dapo Akinrefon wey do the interview for Vanguard ask am
why dem party, All Progressive party (APC) no first gree to support the
national conference wey Bro Jona call for Abuja. He say the way the mata waka
na him make dem dey suspect say e be
like say the mata no go pure, but wen den come reconsider the level say make
den no too dey negative and if dem hammer Federal Government wella, the level
still fit pure. Na him make dem say no lele make we see as he go be, make he no
come be like say na dem be winsh wey dey worry naija.
Wen den ask about the division wey dey wan show face for the
mata, especially among the old Yoruba Babas wey don dey ask for this kain
conference tey tey. He say shey den know say people dey think differently on
mata, unto say the way Baba god create us, but upon dat he never see anybody
for Yoruba land or even Nigeria wey go talk am say make them bone the
conference
On top the matter of
say make all the different tribes waka commot go form their own country, he say
the level no go pure so. We don already marry and we no dey separate, but on to
say the way we dey see things and dey do things no similar, we need to reason
together how we fit make the marriage make sense. He say since 1966 we just dey
form activity for naija we no dey make sense at all, the litu try wey we try as
a country till today, na still those things wey den do wen naija dey operate as
per regions.
The Oga Senator say the first thing we suppose do na to
change the constitution wey we dey use now, he say the constitution no try as
hin no reason say we be different people, so make we first draw better
constitution wey go return us back to the parliamentary system of government,
where everybody go fit flex muscle and show themselves as den like. He say
power too much for the center under this present constitution.
Bros Femo wey still be spokesperson for the senate don gist
us say senate ready to give the conference all the necessary backing to make
sure say the conference this time around no go be like the last one wey be say
na just flex den go flex for Abuja that year.
Bro Femo say na lie some people dey lie say APC go blow abi
na bomb in 2015, he say all the kirakita wey dey happen for inside the party
for now na normal runs wey dey follow parties merger as everybody go first do
initial gragra to show demselves and know who get mouth pass . He say no cause for alarm, if the party Ogas
try well den go control the mata, but if den no do well he fit cause kasala,
but any how e be APC don show and den no ready to mellow now or never. He say e
no make sense as one party just sit down like king on top the country ever
since like say na only dem dey.
He say as for the people wey say he dey beef the Governor of
Oyo State, na pure lie be that o, Ajimobi na Governor, him na senator and den
dey work together for the party good ni, so wetin wan cause quarrel. And for
the dream say I wan become Governor, make I finish the one wey dey my hand
first. Na that one concern me for now, na wen I finish this one go determine
wetin I go do next but for now I no dey dream see Agodi Government House.
No comments:
Post a Comment