Minister of State for Petroleum Resources, Mr. Ibe Kachikwu, on Saturday na him enter one chance for weekend when APC Oga, Asiwaju Bola Tinubu, change am for am on top wetin he yarn for petrol gbege wey dey Naija. Tori yarn us say Jagaban para for the man wey still be Oga for NNPC, cos he talk say he no be magician wey go fit end petrol gbege. Jagaban say the minister suppose dey answer to Naija.
Na on Saturday, Tinubu yarn am for one statement wey he give title say, Kachikwu suppose Sabi say Respect plus beta work go do wetin magic ni fit do. Tinububsay he believe say the bros don misfire ni as per say last Wednesday he must yarn afta meeting with we Presido. When he say he nobfit just do abracadabra take commot pipu for petrol station, say fuel gbege fit no go till May ending.
No comments:
Post a Comment