Anybody wey get hear make he come hear o, Presido don clear
Naija pipu say him o, he no get any kain account or property anywhere outside
Naija, and all him children na for Naija dem dey do their groove and dey go
school.
Na on Wednesday wen he dey swear for the 11 new ministers he talk am
join the plenty things wey he yarn.
Na him Special Assistant on new media mata, Reno Omokiri
a.k.a. Wendel Simlin (dem never pick the guy) loud that
confession by Presido on top him twitter handle. I just say make he just be as he
talk am o, ehn ehn, make we no hear any different thing tomorrow.
No comments:
Post a Comment