E be like Nollywood film on Thursday when former Presido
a.k.a OBJ, a.k.a. Baba Iyabo no gree make the PDP Oga (National working
committee) enter him house wey dey Abeokuta
for Ogun State.
Na to hail am for him birthday wey he take become 77 years
old, wey happen on Wednesday carry dem
go hail Baba, but na like say trailer jam dem wen Security man go inside go
tell Baba say him padis for PDP wan hail am and Baba say make he go yarn dem
say hin no remember say he get appointment with dem o, so make dem drop
anything wey den bring for gate make dem do about turn dey go back to where dem
for come.
But when dem ask the PDP Oga wey dey front for the waka, Mr.
Adewole Adeyanju say how far for the
mata, the guy talk like person wey gentle even though vexnation show well well
for him face but the guy yarn say all wetin him know be say the gateman for
baba house go in make he go yarn baba
say dem dey and he come back come tell them say Baba say him no dey house. The man talk to THISDAY say all of us
know na say Baba don old and na our Baba he be for life and wen pipu don old
all of us know as dem dey behave, na message dem come deliver and dem don try
deliver am so no lele on top the matter. he say as e be say Baba dey enjoy
better health him pray and wish say make Baba still do many better things for
Naija and PDP.
No comments:
Post a Comment