Saturday, May 7, 2016

MAMA T OF LAGELU FM DON READY TO MARRY, AS SHE SAMA US WITH PRE-WEDDING PINSHURES



Solid Mama T, wey be one of the OAPs wey Lagelu FM import enter Ibadan late last year, wey dey do ogbonge shows for the station. Na she dey do Totori Express with World Obobay plus Ogbonge Game Show and she dey scatter pidgin English dey re-arrange am anyhow. That na one of the plenty reasons wey dem dey call am The pidgin English website. Sylvia Briggs, wey be her real name don ready turn full time woman as she dey do her traditional, her Ibile wedding for 21st May for (see more pinshures  afta cut) 


 Enugu, where the sharp guy wey thief her heart for come. Na so she climb her social media handles today go sama us with pinshures wey dem dey call pre-wedding pinshures and dem fine no be small. So we for TPN join the full world pray for dem say the day go make sense and above all the marriage go make senses forever. 
r.

No comments: