Monday, March 3, 2014

BUSH MEAT CATCH HUNTER, DEN CATCH LAWYER WEY WAN ROGER EFCC GUYS.



Na on Thursday, the 27th of February one lawyer cross him boundary as the guy try to roger some EFCC guy for their office wey dey Ikoyi. The EFCC guys dey investigate one mata of contract inflation, misuse of power and chopping of community money at the Federal Medical Center, Owo, Ondo State.

 

When hand touch the lawyer, he start to dey confess winsh say na N1.2m he wan take roger the EFCC guys wey finish him career, according to Oga the Law, na the Oga patapata of the hospital, the Medical Director wey chop the community money give am the cash make he take roger the EFCC guys say make dem relax small for the matter. The honest esquire confess say actually na N1.5m the Medical Director give am, but as the matter come be, him take 300k step down personally and habatically roger the EFCC guys with the remaining N1.2k. EFCC Oga of Media and Publicity say na true den don arrest the guy say den go carry am go court go explain himself very soon.   

No comments: