Wednesday, March 5, 2014

UNCLE JONA DON FIRE FOUR OGA FOR AEROPLANE MATTER.



Uncle Jona yesterday ask like 4 Oga for we country’s aeroplane mata make dem dey go back home say dem don try. E be like say the Presido dey try wash yanmayanma commot from the aeroplane matter for this country ni.
 

But as he be say if one person own no spoil another person own no go better, na him make dem carry some people replace dem immediately yesterday. Those oga wey dem fire na Mr. George Uriese wey be Oga for FAAN before, Mr. Akin Kuotu wey bin dey NCAA, Engr. Nnamdi Udoh wey dey NAMA and Mrs. Chinyere Kalu wey bin dey rule for NCAT.

Na yesterday Presido send dem that message through Mr. Sam Nwaobasi, wey dey advise Our country’s Secretary, Chief Anyim pius Anyim, on top media matter and na that same bros announce people wey dey replace them.

So we say eeyah to those wey dem sack and say congratulobia to those wey dem just appoint.

No comments: