Wednesday, March 5, 2014

SHEY FEDERAL GOVERNMENT STILL DEY ON TOP THIS SITUATION? BOKO BOYS DELETE ONE VILLAGE NEAR MAIDUGURI



No be small mata yesterday as dem boko boys don show say dem no ready to stop or slow down o, as dem attack and delete one village wey be like 40 kilometres away from Maiduguri and take like 20 killometres far from manic, the village wey dem first format on Sunday night. 
 
The attack na just like 12 hours after dem kolobi one Mafa Council Area, where dem for kill like 36 people for the village plus 2 security people. The person wey dey there when dem enter say na around 9.45pm on Monday the bad boys show on top plenty Toyota Hillus Jeep and okada, den just dey shoot like say na war film, dey throw many many things wey fit blow house, and dey scatter people house, and na so dem dey the village till like 2am dey kill people, dey burn dem houses and dey shout “Allahu Akbar”

The bad boys no even respect our country as dem even burn down the police station wey dey the village and dem fall 2 police men  but sha o some gist still dey say our soldier kill some of the boko boys too and say the airforce support dem with dem aeroplane. The Oga patapata of police for Borno say na true everything happen but dem never fit know the number of civilians wey die join the 2 police men wey dem fall. But dem Senator, Senator Ahmed Zannah confirm on telephone say some 11 elderly people wey no fit escape and wey dem children no gree carry run wen the gobe start fall for the matter.

Dem say na later later our soldier people wey don first find their levels come get enough confidence to show face after den don sample the voice of the kain weapon wey dem boko boys dey u and see say dem no too strong like that. But sha o dem say wen the boko boys dey commot dem talk say em dey come back and na that make people dey run commot from the village to Maiduguri.

No comments: