Monday, May 16, 2016

SHUU... U. K. DON WARN BUHARI ON TOP GBEGE WEY DEY SHELE FOR NIGERIA DELTA

UK don warn President Buhari
after the attack wey niger delta avengers don do ontop pipeline.  British Foreign Minister Philip Hammond don tok say make our number one peson
President Muhammadu Buhari say make he chuk mouth into the gbege wey dey shelle for dat region tory yan say one senior British official don yan about the mata for one regional security conference wey dem do for Abuja yesterday. he still com dey yan say dis gboagboa don reduce Naija  output by 300,000 barrels per day, plus say one the main the main export port and two refineries na hin dem don close down.This nko don make our army declare big war na hin go hapun between dem and the militants because say dem wan dey do any how to we nation economy.

No comments: