Some big bros don attack some ladies wey be members of Olumba Olumba church in Calabar, Cross Rivers state. Tori show say The ladies dey part of the 144,000 members of the olumba wey be den say be Virgins and na for Mbupka/Ambo streets for around 5am when dem dey go for morning worship when the yawa hapun. Den say as the three ladies dey comot for the headquarters na hin the big bross show face. Dem colet money and other things from dem. Pipu wey dey the area com dey yan say no be today dis kain tin don dey hapun say e even get one tym wey dem rob one woman wey get belle still com chuk am knife because say she bin shout for help dem com dey yan government say make dem com chuk hand for the matter before dem bross fiinish all of dem for the area.

No comments:
Post a Comment