Naija pipu funny die, we can Sabi form. Shebi na for time wey no too tey Federal Government say make police collect 10,000 pipu join police wey Police Service Commission (PSC) come Loud am. Wetin dem talk say dem dey find na, 500 Cadet ASPs, 500 Cadet Inspectors, 1,500 Specialist Officers and 7, 500 Constables. E no tey at all as dem polongo finish wey dem shock pass electric as Naija pipu wan take application finish dem life. According to Ikechukwu Ani, wey be Oga for Press and Public Relations for the Commission, between April 24 and May 2, 2016 he say na like 843,008 applications na him dem don collect. When he break am down, e show say 243,327 applications na him pipu submit for ASP, 197,990. For inspector and 401,691 wan be Police Constable. E no try afta Dat, the number don gbera go over one million, na him make pipu come dey wonder if na so pipu like police for Naija. Even Oga Patapata of Police say him no Sabi say Naija pipu like Police like Dat O..... NAIJA pipu I hail oooooo

No comments:
Post a Comment