Police for Enugu State, don catch one artisan, Okwudili Nwodo sake of say he dey go repaint motor wey dem thief. Tori yarn us say Nwodo dey work with bad guys wey dey thief car, as dem official painter, wey dey help dem change color of cars wey dem thief before dem sell am give anoda person. We hear say plenty cars wey dem thief dey for Nwodo shop wey dey for Presidential Road, Enugu, when police for Enugu State go catch am. Police say na when dem dey shine light on top the work wey the bad guys dey do, dey see the guy work. Tori yarn us say the bad guys wey one Kingsley Okoro lead, carry gun go collect one black Lexus sports utility vehicle, wey get registration number, ISD 265 DJX, from the owner for Ebenano Ekwe wey dey for Isu Local Government Area of Imo State, on May 20. Na afta Dat dem come move am go Enugu, go give Nwodo make he change hin colour.
No comments:
Post a Comment