One lecturer for the Federal College of Education wey dey Obudu, Cross River State, Dr. Walter Ibe, na him dem kidnap on Saturday from him house by some badt guys wey carry gun. Ibe, wey dey Department of Computer Science, na him dem carry go place where nobody sabi, but we hear say dem don free am early momo on Sunday. We hear say the pipu wey kidnap am bin dey ask for 5 Million Naira, but we Neva Sabi maybe dem pay abi dem no pay when dem release am. Make we no forget say na just 3 weeks ago dem kidnap 3 pipu wey for University of Calabar staff quarters and dem free dem afta dem pay 5 Million Naira. Ibe, wey be Pastor for one Pentecostal Church for Obudu, dey him house on Saturday night when the badt guys rush enter him house and dem carry am commot for when him family pipu dey. Na sharperly dem halla him family for phone say dem dey find N5m ransom. But the state Chairmo for Pentecostal Fellowship of Nigeria, Pastor Lawrence Ekwok, wey confirm the level, no fit confirm am if dem pay the money abi dem no pay.
No comments:
Post a Comment