Monday, May 30, 2016

THEOPHILUS DANJUMA DON BLAME BAD LEADERSHIP FOR BOKO HARAM

General Theophilus Yakubu Danjuma son yan say the birth plus rise of Boko Haram insurgency na sake of say we get bad governance. Nigerian Tribune reports yan say  the former chief of army staff tok dis one for the 3rd annual Chief Ogiri Okoh memorial lecture wey Idoma National Forum Danjuma organise. E still com  note say the destruction caused by Boko Harm insurgency plus the many years wey the group take terrorise the country so, na hin dey traceable to bad governance plus "intelligence failures, lack of political will, absence of state presence for local areas, lazy lazy wey the security forces dey do, loss of territory to irregular forces, say all dis things wey we face so na becos say we get bad governance plus state failure."

No comments: