Naija Army on Wednesday don bring six soldiers from various units for the 2 Division of the Nigerian Army, Adekunle Fajuyi Cantonment, Odogbo, Ibadan, come before one General Court Martial on top say dem kpain pipu plus some other bad things. We hear say some of the soldiers kpain person, some thief, some no do dem work well, some even chop ogbono of fellow soldier man wife plus other things wey make Naija military dey shame. The mata start after the GOC for the division, Maj. Gen. Laz Ilo, open the General Court Martial for Ibadan, and na Brig. Gen. Ibikunle Raji dey siddon on top am. The pipu wey dem carry come the court na one Major, one Captain, one Lieutenant , one second Lieutenant , one Corporal plus one Private. The GOC say military no dey take nonsense and no be now dem go start.
No comments:
Post a Comment