Oma Wonder wey her real stage name na Omawumi just dey trend anyhow yesterday as video show her Waka commot for one interview with HFtv where Zainna the person wey dey interview her ask her how wetin dey circulate say she dey high dey smoke dey affect her image as per role model wey she be. Na so Omawumi carry vexnation cut chain for the babe say shey she don see her high before abi na which kain falling hand question she dey ask am for national television, shey you wan fall my career ni. AFTA Mrs. Yusuf rake finish, she just stand up Waka commot for the interview. And since yesterday pipu don dey hail her say she make sense as she carry vexnation Waka commot.
No comments:
Post a Comment