Super star, Tuface Idibia wey just carnage name become TUBABA go get degree on the 10th of May, even though the degree no be one wey dem study for, na one wey dem dey fash person wey don do well and na Igbinedion University, Okada, for Edo State wan sama TUBABA. He Loud the good news for him Instagram page yesterday nite, come say na all of he invite O. So if you wan go make you halla us, so we go tell you where bus go dey wey go pick us go hail TUBABA as he collect the degree. We say congratulobia Bros.
No comments:
Post a Comment