Wednesday, March 5, 2014

COME SEE AZONTO AND ETIGHI YESTERDAY WEN NAIJA POLICE PROMOTE 24,118 OFFICERS




No be small thing yesterday, as Naija Police decide say make dem ginger the swagger of some of dem officers wey don try do well for this period, those wey don do well pass Jack Bauer for the assignment wey den give dem. Na him make dem Oga Patapata Mohammed Abubakar declare surplus yesterday say make dem promote 24,118 officers.
 

Na only one person dem promote from Commissioner of Police to Assistant Inspector General of police and different promotion to different level for different people, cos even shoes get size, na so CSP Frank Mba who be the PRO for police talk am yesterday wen he dey deliver the good news. 

Oga patapata come advice dem say make dem no see dem promotion like say na only for flexing things o, but na make dem try do well and do better things with dem new power o and say make dem rededicate demself to the work wey dem choose.

No comments: