Saturday, May 21, 2016

PARTNER MOBILE DON COLLABO WITH 2BABA AS DEM LAUNCH FOR NAIJA

Partner Mobile officially don by demsef land gidigba for we Naija mobile devices market for one four points event for Sheraton Hotel, in side LASGIDI. For the launch, the brand showface 3 android-based mobile phones - PS1, E15 and KS1 - to news men, trade partners plus other pipu who wey gather chuk yansh for the event. The Chief Operating Officer for the company, Simon Klepper, who dey gist the pipu on top the pakage yan say the company go begin carry gramophone dey yan evry evry for we Naija make dem say beta pakage don land gidigba.. Nigerian pop star 2Baba Idibia wey follow dey the event, con yan say hin too follow chuk body for the pakage E con  announce hin colabo with the company for hin "Trip & Treat" promo wey go make  lucky winners wey buy Partner Mobile android phones go join him for one week trip to Nairobi, Kenya. Partner Mobile finally finally con dey yan say dem get other pakage wey dem go begin show face for Africa

No comments: