One High Court for Appeal, wey dey Abuja, on Thursday say make dem go keep the Oga for Training and Operations for the Nigerian Air Force, Air Vice Marshal Olutayo Oguntoyinbo for Kuje Prison, make he dey go while away life, before dem finish him bail mata wey go shele on June 6. Justice Olukayode Adeniyi na him yarn dem the order afta Oguntoyinbo beg say na lie him hand pure and na lie say he collect N166m gift from one NAF contractor. Tori yarn us say he collect the gift from the contractor, Société D' Equipment Internationaux Nigeria Limited, when he dey do work wey government dey pay am make he dey do. EFCC say the man collect N166m gift from the contractor when he be the the Chief of Training and Operations for the Nigerian Air Force. Dem even say na him company account dem take Roger am the money, wey hin name na Spaceweb Integrated Services Limited, wey dey for Wema Bank Plc. Dem say na Oga be Managing Director for Spaceweb Integrated Services Limited and na only him dey sign to collect money for dem account.

No comments:
Post a Comment