For one gist wey dem write for Abuja by the presido Senior Special Assistant ontop Media and Publicity mata Mallam Garba Shehu. President Muhammadu Buhari dey grit pipu plus government of Egypt ontop the crash of jet Flight MS 804, wey make plenti pipu rush rush port go heaven. na ontop fone we presido grit Egypt presido Al Sisi for yesrerday evening E com dey yan am say Naija pipu follow feel the pain wey Egypt dey feel. Buhari still con pray say make we baba God comfort all the pipu wey dia peesona pesin follow dey the crash.
No comments:
Post a Comment