Miss Simplicity - Rachael Okonkwo wey pipu know as nwa nsukka na one actress wey me I dey gbadun sum of her film wella base on sey she dey knw hw to enta inside her character make she for fit play her role wella.... Rachael celebrate wey celebrate her bday late last month don sama us wit more pinshures from d party on her IG page o.... D pinshures come make me dey think sum tin o: E wan be like sey tomato no cost reach all dis pipu side o, dem just dey spend moni dey way dem like o jare, moni gud sha.... Abeg make una see d pinshures afta d cut...
No comments:
Post a Comment