Thursday, June 2, 2016

AFTA 2 PIKIN, DAKORE AKANDE SHOW OF HER BELLE WEY STILL FLAT LIKE LCD



Miss Simplicity- Dakore Egbuson wey marry Olumide Akande for January 17, 2011 nd wey don get two beautiful girl pikin na one actress wey fine wella, wey knw wetin she dey act o nd wey be d first Amnesty International ambassador for 2005 naim don prove give pipu sey she no join women wey dey loose their fine body afta marriage o. For d 2016, Ankara Festival wey she attend for Los Angeles, Dakore show pipu wit her all white two piece pant nd cropped top wey show her belly sey she still dey kampe o. (see pinshure afta the cut) 

 Her husband Olumide Akande com show him appreciation for d gud tin wey Baba God bless ham wit o wen him post d pinshure for him IG page o nd he com write sey tho him no dey always dey tok abt him wife pinshures for Instagram bt him o, him like him wife fine body for dis pinshure o, make I put pick some of d words wey he yarn o "Don't normally do this but Damn! Remind me to thank your parents one more time" Chai see d way Olumide Akande dey baff Dakore wit sweet words, see hw e dey praise ham oo. Abeg dis one na lesson for men o, make una dey try appreciate wife wey Baba God bless una with oooo.

See d pinshure afta d cut.

No comments: