John Bray, wey be USA consular general to Nigeria, tok say hin country dey ready to help President Muhammadu Buhari government to finish the ongoing gbege for South-South region by Niger Delta Avengers plus other militant groups. Tori yan say Bray gist this one wen E dey visit the former national chairmo of Association of Traditional Rulers of Oil Mineral Producing Communities of Nigeria plus Pere of Seimbiri Kingdom in Delta state, HRM Charles Ayemi-Botu,for hin Edjeba Palace Annexe in Warri. Wen E dey yan ontop the visit HRM Ayemi-Botu yan say Bray visit to seek solution to renewed militancy. plus the recent bombings of oil and gas installations for the region Niger Delta region.
No comments:
Post a Comment