Miss Simplicity- Kunle Afolayan wey plenty pipu knw as Aresejabata na one pesin wey no dey like make stain dey him name nd he like him fans die, na on top dat one naim make ham use him twitter nd IG acct wey be @kunleafolayan nd @kunleafo take come warn him fans sey all those Facebook account wey get him name no be him own o, he tok sey na 419 dem naim dey use him name for Facebook o. He tok sey na only d Facebook acct wey dem put blue verification mark na hin be him own o.
He tok sey na one of him frd naim call ham to tell ham sey 419 dey use him name deceive pipu afta dem don promise to give d pipu laptop, iPad, phone nd plenty plenty tins o. He beg him fans sey make dem block those pipu o. He com still sama dem wit 14 Facebook acct wey dey use him name nd picture nd wey be fake.. Hmmm na wa oooo, abeg o make we be careful oooo... Thanks for d warning oga Aresejabata....
No comments:
Post a Comment