Monday, May 30, 2016

LOL... SEE AS GOD CATCH THIEF WEY WAN THIEF OKADA FOR INSIDE CHURCH

Pipu wey go church for Foursquare Gospel Church, Magboro, Ogun State, shock on Sunday after one thief Dodge body enter dem church go move one Okada wey be for one of dem memebers. Thank God for dem security pipu for the church wey no dull, na smallnremain make he carry the Okada run. The security pipu sharperly halla other pipu wey get Okada for the church,  and na dem come pursue the guy before dem catch am as he wan enter Lagos-Ibadan Expressway. When dem catch am, the Badoo wey say him name na Raymon, but when hand touch am well well,  the guy go back to default setting say him name na Ramoni, said na hunger make am thief. Na police from Ibafo division dem late Halla wey come carry am commot. One member of the church, Ogungbola Adenekan, say the mata shele around 1pm when the men dey do dem fellowship.

No comments: