Monday, May 30, 2016

NO BE FIRST TIME WEY HE GO TRY KPAIN MY SISTER BE DIS- SISTER OF WOMAN WEY HER HUSBAND KPAIN

The younger sister of Mrs. Roseline Sougie, wey dem say her   husband of 26 YEARS kpain her, say na so the man almost beat am doe last year O,  before he come later kill am dis year. The sister, Mrs. Philomena Shaibu, yarn news pipu say the husband, Jafaru Sougie, carry vexnation take pillow take cover the nose of the woman wey get 5 pikin when she dey sleep. She say na the die wey Roseline die on Friday for their house wey dem rent for Araromi Street, Oshodi, Lagos, na him the man take finish the beating of him wife wey he dey always do. Dem even say dem last pikin, Happiness just do her 9th year birthday for Shaibu house for Ikorodu on Sunday. Tori don first talk say na knife 49-year-old Jafaru, wey no get work, take cut the neck of him wife around 2am on Friday, na afta Dat he come swallow poison. Dem say as he come enter bathroom go vomit, na him one of dem pikins, Richmond, and him Mama sister wey sleep for parlor say make dem go wake Roseline make she come see her husband, na him dem see say she don kpain. We hear say na Roseline, wey be 46 years old be the breadwinner for the family and she don dey reason say she wan end dem marriage, but dem advise her make she no do Dat kain thing cos of her pikins dem.  Shaibu on Sunday say her sister gats run go dem village for Edo State in 2015 after the husband wan kpain her as dem dey argue dat year.

No comments: