One Plateau United player, Sabole Shehu don kpain for one motor accident wey shelle for Kaduna expressway on Sunday May 22nd, exactly six days to hin wedding wey suppose shelle for this Saturday May 28th. Plateau United media officer, Albert Dakup Shehu tok say no dey available for Sunday's game against Kano Pillars because say dem give am chane make hin go and prepare for hin wedding ceremony and na hin parents he wan go seeooo when the accident shelle. May his soul rest in peace, Amen.
No comments:
Post a Comment