Tuesday, May 17, 2016

IBADAN ON FIRE... ENTERTAINERS DON VEX START GBEGE ON SOCIAL MEDIA

AFOUDA - Earlier today ba him we clear una say OYO State Government dey reason am, in fact dem wan start am already to dey collect money from pipu wey dey do show plus event for the State. Rotimi Ige wey everybody sabi as Roy Media wey dey front for dis struggle dey clear everybody doubt say the mata don red finish O. Bcos to do show abi events now, you go first collect permit and we hear say na from like 10k e dey start. So everybody wey get mouth abi hand for entertainment for the State don dey yarn dem mind O, and make e for no lost dem don sama everybody the Twitter handle of pipu wey dey involved for the mata, so pipu go fit let dem Sabi wetin dey we mind. The pipu na @BabajideFadoju wey be the Special Adviser/Assistant to Governor on top Social media mata, @Oyostategovt plus including the Governor hinsef @AAAjimobi. As the Dp dey fly na so bc's dey fly and we no go gree until dem commot the yeye law wey dem wan take drag Ibadan entertainment go back.

No comments: