Wednesday, May 4, 2016

I NO DEY YAB BUHARI O, NA GINGER I DEY GINGER AM - FAYOSE

OMOBOLA - Ayodele Fayose don talk say he no abuse our presido Buhari BT he dey ginger am ni. He talk this wen he dey lecture at the event wey oyo state chapter of the Nigerian Union of journalism(NUJ) organise, wey den call "Journalism and politics". He talk say Buhari na hin grandfather say he no fit abuse him, make the federal government no dey blame PDP for wetin dey apen for our country. 80 per cent of pipu wey vote for Buhari wey dey West know no him, pipu vote for him cos dem want change, say PDP no dey power again so make dem stop to dey blame PDP, fuel subsidy don go, food subsidy con take over, queue plenty for filling station, light ba zero, Nigerians dey wrong way Bcos u cannot give person wetin u no get. He con talk say time dey for everything, time to retire Bcos of the brain.

No comments: