Some badt guys kidnap and kpain one doctor wey dey work for Lagos University Teaching Hospital, Idi-Araba, Lagos, Thomas Adekoya-Cole, for Itele area of Ijebu, Ogun State. Tori yarn us say the 60-year-old Adekoya-Cole, na consultant orthopaedic surgeon for LUTH, na him dem kpain when he go him village for one owanbe. Tori yarn us say na cutlass dem take cut am anyhow around 7.30am on Sunday. We hear say dem report the mata give police Area Command, Ijebu, plus including Igbeba Police Division.
Tori say dem first rush am go one private hospital for the area, where dem confirm say he don kawasaka. One person for Ijebu Ode say the bad guys come Akongi Street, for Itele area for Ijebu, where some pipu wey be traditional worshippers dey do dem own normal normal and dem cut one of dem, wey him name na Omotayo Ogunbowale die. He say as the mata turn gobe, everybody tear race go hide for dem house. We hear say na later dem come show again around 7am on Sunday and dem come kpain Adekoya-Cole.
Monday, May 30, 2016
EEYAH... BAD PIPU DON KPAIN LASU DOCTOR FOR IJEBU-ODE
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment