Governor Samuel Ortom of Benue state don yan say the invasion of hin state by Fulani herdsmen dey beyond just agitation for grazing space. According to Ortom, the herdsmen no just com graze, but to steal, kill plus destroy. The governor yan dis one when he dey hosted governors of the All Progressives Congress (APC), wey go do him a condolence visit ontop the Fulani herdsmen invasion for hin state his state. Governor Samuel Ortom of Benue state yan say na about 12 local government areas nahin dem don attack plus many communities reduced to rubbles. He con list the local government areas wey dem don attak by the Fulani herdsmen to include; Agatu, Guma, Makurdi, Logo, Katisna-Ala, Kwande, Gwer West, Gwer East, Buruku, Tarka, Obi and Oju local government.
No comments:
Post a Comment