Friday, May 27, 2016

BAUCHI GOVERNOR DON HAYAJ FAYOSE ON TOP FULANI MATA

The Governor of Bauchi state Mohammed Abdullahi Abubakar don  condemned the statement wey the Ekiti state governor, Ayo Fayose, tok wey E dey yan say make Fulani herdsmen leave Ekiti state sake of say the yawa wey dey hot between farmers plus cattle herders suspected to be Fulani. Abubakar tok say wetin  Fayose yan so no make sense plus say no be national leaders, especially state governors, suppose dey yan dis kain tin. Abubakar con yan say E no sweet hin belle as Nigeria never find lasting solutions to such clashes wey don cause the  death of hundreds of naija pipu.

No comments: