Miss Simplicity - House of Maliq don sama us wit their May Edition Magazine nd na Yemi Alade, Rechel Okonkwo nd Swanky Jerry naim tanda for d cover of d magazine o. Yemi Alade wey be confirm musician nd Rechel Okonkwo wey be ogbonge actress naim Glamhaus style for d magazine bt Swanky Jerry as per sey him dey design clothes for celebrity too, na him fashion hose wey d name be Swanky Signature Styling naim style ham for d magazine. Make i no lie una, dem three make brain for d cover pinshure nd dem show us wetin e be to be stars for d magazine o. Congratulation ma'ams nd sire from d TPN crew..... (many more pinshures below)
No comments:
Post a Comment