Miss Simplicity - Na Monalisa Chinda naim dey d cover of d May edition of Genevieve magazine nd d actress sama us with her beautiful smile o. For inside d magazine, d actress tell us hw she take waka her life journey before she come find true love for Victor Tonye Cole wey be her husband now arm o. She tok sey she be think sey all men na useless pipu o bt sey now she dey hapi sey she don see dem for different way o. Hmmm Monalisa tok sey marriage na beta tin for single women o bcos if dem reach 30 or 35 nd dem neva marry, pipu go dey call dem dead engine... Hmmm true tok ma'am, even sum parents go dey give their girl pikin heat if she neva marry at 30 or 35 oooo. U dey right ma'am..Personally I sey congrat o nd collective too, me nd d whole TPN crew dey sey Congratulobia...
No comments:
Post a Comment