Office of Naija presido don reply Britiko Prime minister, David Cameron, on top him misyarn say Naija and Afghanistan na dem corrupt pass for the full world. For one statement wey dem Sam us by the Senior Special Assistant to Presido on top Media and Publicity, Shehu Garba, the Federal Government say wetin Cameron yarn no describe wetin dey shele for Naija now as per say Sai Baba dey work against corruption. He say the thing embarrass us is Sai Baba sey do many beta work and everybody dey look us like gonfabi. He say e be like say na the old FOTO of Naija Oga Cameron still dey look like new. He say na everything don dey change for Naija and that na one of the reasons wey dem choose we presido as one of the keynote Speakers for the conference wey dem go first do before the summit.

No comments:
Post a Comment