Wednesday, May 11, 2016

FEDERAL GOVERNMENT DON TAKE STYLE POLONGO SAY DEM WAN INCREASE PETROL MONEY O... TO HOW MUCH?

Minister of state for Petroleum Resources wey still be GMD for NNPC, Ibe Kachikwu, say Federal Government will go soon do new policy for we Petroleum sector for time wey no go tey again. Na for the 2nd town hall meeting wey federal ministry of information and culture arrange for Kaduna state yesterday May 10th, Kachikwu say the new policy go allow petrol price for Naija make e follow international market.
Pipu wey Sabi for the mata say  the new policy go allow oil marketers make dem decide how much dem wan dey sell dem products while the Federal Government go continue to put money wey dem dey call subsidy join the products for all NNPC station. He say for the new policy sha O,  petrol price fit go N130 per liter. Lobatan.... Una for go straight to the point say una wan add money join, which one come be new policy again. Yeye dey smell.

No comments: