Wednesday, May 18, 2016

BUHARI DON COLLECT WORK FROM IMMIGRATION OGA, MARTIN ABESHI HAND

We Presido Muhammadu Buhari don sack The Comptroller -General of Nigerian Immigration Service (NIS), Martin Abeshi, for yesterday. Tori dey yan us say wetin the federal government do so fit be because of the way wey Abeshi dey behave for office since the time wey dem don chuk am for office. As the staff of the NIS ear say Abeshi don vamut so dem don begin pop Champaign say God go bless federal government for the move wey dem do so. Meanwhile Some officers don expose the mago mago wey the comptroller general. dem even carry biro take write petition to we Presido Muhammadu Buhari, and for the letter so dem accuse Abeshi say he dey collet bribe from officers

No comments: