Miss Simplicity- Bcos of d love wey Flavor dey share wit Chidinma for TV especially d way dem two take kiss for d video of their song "Ololufe" pipu don begin dey carry news sey dem two dey date each oda o. Even their fans no gree sey dem two no friend each oda o close mouth o base on sey flavor nd Chidinma close wella o bt Flavor don come out come tok sey abeg oooo, me nd Chidinma na just frds o.
Wen Soundcity interview d Igbo crooner, Flavor tok sey him no dey date Chidinma o.
Me sef remember sey wen dem interview Chidinma for her birthday na d same tin wey Flavor tok naim she tok too bt if dem date sef, dem two na baby?
Check out these pinshures nd tell me sey dis two pipu no make correct team... Abeg make una free dem oooo
Wednesday, May 11, 2016
ABEG O, ME AND CHIDINMA NA FRIENDS O - FLAVOR
Subscribe to:
Post Comments (Atom)








No comments:
Post a Comment