Popular APC Singer, Dauda Adamu Kahutu wey everybody sabi as Rarara, na him dem don kidnap, but dem sha don free am afta he roger dem N2.8 million. When he dey confirm the mata to Daily Trust Sunday, Rarara say na Thursday dem pick am for him house wey dey behind Sahad Store for Zoo road wey dey Kano metropolis. Rarara explain say na follow dem follow am to him house around 1am that day and dem take force enter him car and drive am go Tudun-Fulani around Darmanawa quarters for Kano. He say as dem dey go Tudun-Fulani, na him dem clear am day dem be hired killers and dem don pay dem to kpain am but if he fit Roger dem, dem go free am, na so I clear dem say I get the cash. Naso I carry all the money I get wey be; N2.8 million. He say when dem reach Tudun-Fulani, dem say make he commot all him clothes and make he lie down, na so dem carry him car run and the money run.
No comments:
Post a Comment