Ekiti State Governor, Mr Ayodele Fayose don talk say Federal Government dey plan to suffer Naija pipu as he wan increase Value Added Tax (VAT) from 5 per cent, wey he dey now to 10 per cent, he say dat kain thing no suppose happen now wey the bad economic policy of the presido still dey hammer pipu. Vice Presido Yemi Osinbajo don yarn on Thursday for Lagos say the current 5 per cent VAT rate for our country too low, and he still say the Federal Government go increase number of pipu wey dey pay tax this year. When he dey yarn through him Special Assistant on Public Communications and New Media, Lere Olayinka, Governor Fayose say if dem increase VAT abi any tax now, na to suffer Naija pipu more O. He say Naija pipu dey suffer and the little wey dem still take dey hold body na him federal government still wan collect from dem as dem wan increase VAT. He say Chai, Dat one na wickedness O. He say under 3 months, electricity money don increase and power no make sense, N50 stamp duty na him dem put for bank customers head for any money wey enter dem accounts thru electronic transfer, cash plus cheques; petrol now dey sell for like N400 per litre and now dem still dey talk say dem wan increase VAT to 10 per cent, he say dem no think Naija mata well at all.
No comments:
Post a Comment