Man Utd don still enter anoda gbege as dem don sama dem fine on top say dem late reach White Hart Lane on Sunday afta dem still go chop beating for Tottenham Hotspur hand yesterday. The Red Devils, fall yakata to Spurs with 3-0 and he come be like say Dat one never even do dem cos e be like say as e dey go dem fit no go Champions League next season, then the Premier League still wan punish dem on top as per say dem be late Comer. United no quick come and dat na why dem start the March for like 30minutes late. Tori yarn us say na traffic hold dem and rule for English Premier League be say any team wey delay kick-off by 15 minutes or less go chop fine of N2,250,000 (£5,000). But Man U delay kick-off for 30 minutes so dem own fine fit heavy pass wetin dey book.
No comments:
Post a Comment