Monday, April 11, 2016

GOOD NEWS.. WETIN GO HAPPEN NOW WEY NNPC AND IPMAN DON SETTLE DEM QUARREL

Federal Government don start to dey release petrol to Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (IPMAN). One statement by Mr Lawson Ngoa, wey be Secretary for IPMAN Reconciliation Committee, on Sunday for Abuja talk am. Make we no forget say Minister of State for Petroleum Resources, Dr Ibe kachikwu, na him form one 14-man committee make dem settle gbege wey dey shele for IPMAN  and make dem see say petrol dey for Naija. For inside the statement, Ngoa say the release of the product na part of how dem wan settle the 7,000 loading tickets for IPMAN wey still dey ground.  He say some marketers don confirm say dem don start to dey load for Lagos cos of wetin the Committee do.  He say na IPMAN dey control over 80 per cent of where dem dey sell petrol for Naija and say dem members bin no dey get petrol from NNPC sake of the gbege wey bin dey shele before.  Ngoa say the Committee don dey do to see say the products dey everywhere for Naija.

No comments: