Tuesday, March 15, 2016

SPLASH FM INTEGRITY MARATHON GO TUFF DIS SUNDAY



For 8th years now,  the full Ibadan dey stand still for Splash Fm integrity Marathon Race. And e be like say dis year own go be gbosa. Cos the ginger wey dey surround am no be here. Pipu dey carry head enter from all over the world for the race,  shebi na money mata we dey talk. 


One thing wey go come make am dey interesting wella dis year na the special Race for a Course, wey dem just introduce,  where pipu go volunteer to run for some selected charitable course. And dat one na according to person ability. Meanwhile as dem dey run,  those of us wey no fit run go dey Liberty Stadium dey groove as we dey wait for dem. Na fun all the way and I no go fit miss am.

No comments: