Tuesday, March 15, 2016

BURKINAFASO VS MAFIA, CULTIST KPAIN 2 STUDENTS TAKE DEM HEAD DO GOAL POST





See yeye O, cultists on Saturday night go comot the head of 2 Abia State University Uturu students,  dem go carry dem head stake do goal post for ball. Tori yarn us say dem roommates carry different injury. Pipu wey kpain na Ebuka Nwaigbo, wey dey 300 level for the  Department of Estate Management plus Samuel Ethelbert, wey be 300 level student for the Department of Political Science and till dem kpain,  dem dey stay for Chi-Doo Lodge along the Uturu-Afikpo road. (see pinshure of the fine boys wey dem kpain) 


Tori yarn us say pipu wey kpain dem na members of anoda cult group wey come revenge for one of dem members wey dem fall last month. Dem say e don tey wey the 2 cult groups Burkinafaso and Mafia dey fight each other on top who get levels pass.

No comments: